Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State gornment say dem want make pipo begin shift from poor light to solar power for their houses and small businesses.
Commissioner for Energy, Biodun Ogunleye, say like dis dem dey work on system wey go make pipo pay for solar like how dem dey pay NEPA bill every month.
Ogunleye yarn dis one during one solar project launch for Radio Lagos and Eko FM for Ikeja.
E explain say dis plan go help residents reduce dependence on unreliable electricity and enjoy steady power supply.
Ugunleye say, di plan na to start with about 100,000 solar home systems for di first phase of di project.
Written by: Ridwan Agbomeji
electricity lasg nepa soalr power
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026