Oga Minister of Work, David Umahi don tell im South East leaders say make dem come out with dia full chest support Bola Tinubu based on wetin di senior man don do for south east pipo.
Im tuk dis one on Thursday for Enugu during di opening of completed part of di Enugu, Onitsha federal highway.
Umahi come tell Hope Uzodimma to organise leaders for di zone make dem loudly support di president and spread di message.
According to Umahi, im go continue to praise Tinubu no matter wetin people dey tuk for social media, because im believe say di presido don solve di marginalisation problem wey di South East dey face.