White House officials, all di way from united state of America on Monday don konfamate say dem dey consider one 45-day ceasefire deal between U.S. and Iran for di Middle East war.
Di senior men wey tuk with Agence France-Presse, say di only tin be say Donald Trump never sign di deal.
Dem explain say na mediators bring di proposal as part of efforts to reduce di fighting, but Trump administration still insist to continue di military operation wey dem call “Epic Fury,” so ceasefire never start.
Officials add say Trump go address di mata later today for one press conference by 1:00pm (1700 GMT), where e go explain wetin gornment plan to do next.