By: Esther Ayoola
Former Vice Presido, Atiku Abubakar don raise concern say why Presido, Bola Tinubu go send request give Senate for Abuja make dem approve $516 million external loan.
Di senior man put dis for news statement on Friday wey him aide Phrank Shaibu release,
U sabi say, Senate Presido Godswill Akpabio read di president loan request letter for plenary yesterday.
Tinubu say im need di loan to fund Sections 1, 1A and 1B of Sokoto–Badagry Super Highway wey go connect states from Illela reach Badagry.
For Atiku and some economists, say di borrowing nor too clear and e fit increase Naija debt, asking di gorment to explain beta.