By: Jolayemi Olajide
US Presido, Donald Trump don scata table say, even im sef nor go pay $1,000 ticket price to watch USA vs Paraguay for 2026 World Cup opener.
Di tournament go start June 11, with US, Canada and Mexico as co-host, while USA go begin dia campaign for Los Angeles on June 12.
Trump tell media say im no even know say ticket reach dat amount, but im go like watch di match, just say price too high.
FIFA dey face plenty criticism for di expensive ticket system, say dem price group stage games based on team popularity and also add big resale fees.