World Cup 2026

12 Results / Page 1 of 2

Background

Sport Yarns

Messi Set to Battle England as 39-Year-Old Legend Chases Another World Cup Glory

By : Jolayemi Olajide Lionel Messi go finally face England for di first time in im career as Argentina and England prepare for Wednesday World Cup semi-final. Di 39-year-old captain just play im 200th match for Argentina after dem beat Algeria for di group stage, and e still dey hope to carry im country reach another World Cup final. Messi international journey start for 2005 when e make im debut […]

todayJuly 14, 2026 14

Uncategorized

Rudi Garcia Vow To Shock Spain For World Cup Quarter-Final!

By : Jolayemi Olajide Belgium coach Rudi Garcia yarn for Los Angeles on Thursday say dem dey ready to shock Spain for dis Friday quarter-final game. Him talk say dem get full belief to win because dem come ready to give Spain heavy vawulence despite wetin people dey think. The team show say dem dey standard after dem wire USA 4-1 during the round-of-16 stage to qualify for dis level. […]

todayJuly 10, 2026 9

Sports

Former Eagles captain Ekong confess say Watching World Cup for TV dey pain body

By Oluwatosin Ibrahim Former Super Eagles captain William Troost-Ekong don drop bumbshell  shame wear am agbada, and caftan as super eagles nor qualify for di world cup. Im yarn dis one during one media tuk, tuk on tuesday for social media post. Ekong explain say normally, Super Eagles na di akpormiemie of any international competition and, as dem nor go dis one, say di world cup nor too sweet.  

todayJuly 8, 2026 45 11

Sports

Belgium Shock Senegal with Late Comeback, Knock Senegal Comot 3-2

Nor be small drama, as Belgium complete one big comeback after beating Senegal 3-2 for extra time inside World Cup last-32 match wey happen for Seattle on Wednesday. Senegal bin dey lead 2-0 through Habib Diarra and Ismaila Sarr, but Romelu Lukaku and Youri Tielemans score late goals for di last four minutes to force extra time. For di 125th minute, VAR confirm penalty after Lamine Camara foul Tielemans, and […]

todayJuly 2, 2026 24 2

Sport Yarns

World Cup Gbege, Police Gbab Ivorian Star Elye Wahi Over Betting Scandal

By : Jolayemi Olajide Nor be small gbege, Ivory Coast striker, Elye Wahi, don enter world cup hot soup. According to report, French police arrest am just two weeks before di  2026 World Cup over alleged spot-fixing. Omo, the gist be say the 23-year-old allegedly collect yellow card on purpose during one Ligue 1 match between Nice and Metz back in May, all just to settle one dirty betting arrangement. […]

todayJune 18, 2026 13

Sports

Bellingham Tuk Wetin Spoil England Euro

By: Shalom Ovie England midfielder Jude Bellingham don talk say Three Lions squad dey more united and connected as dem prepare for dis summer World Cup. Im say na beta wire, coach Thomas Tuchel to connect di quard compare Euro 2024, wey some tins no go well. According to Jude, too much expectation from fans and outsiders contribute to di problem.

todayJune 12, 2026 15

Sport Yarns

Iran Football Team wan take Risk enter 2026 World Cup Base

By : Jolayemi Olajide After all di plenty yanga,  Iran football team  wan enter di 2026 world cup through  Spain dis weekend. Di  team dey face serious visa delay from both Mexico, where dem wan stay for di tournament, and di United States, wia dem suppose play all dia three group matches. According to di country football chief, Mehdi Taj, dem suppose  get the Mexico visa by Tuesday or Wednesday.

todayJune 2, 2026 35

Sport Yarns

Super Eagles Coach Eric Chelle Beg Nigerians Again As Eagles Miss World Cup

By : Jolayemi Olajide Super Eagles coachie Eric Chelle done apologize again to Nigerians as di team amaka everybody nor  qualify for di 2026 FIFA World Cup. The Franco-Malian coach, Wey start to dey manage the team since January 2025, say e still wan remain for the job after im current contract finish. As e remain like six months for im contract, nobody really know wetin go hapun next because […]

todayJune 2, 2026 13

Sport Yarns

Ronaldo Make History Again As Portugal Release World Cup Squad

By: Esther Ayoola Portugal national football team don confirm dia squad for upcoming FIFA World Cup 2026, with Cristiano Ronaldo set to make record sixth appearance for di competition. Head coach Roberto Martinez tuk say di selection carry emotional weight, especially as dem also honour former international Diogo Jota. Di 41-year-old striker being part of di squad mean say, im na one of di first 3 male player ever to […]

todayMay 20, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds