obodo oyinbo

US Open Tuks on How ISIS Take Shift Base Enter West Africa, Lake Chad

todayMay 12, 2026 3

Background
share close

By: Esther Ayoola

United States don warn say terrorist groups like ISIS  don dey move dia operations enter West Africa and Lake Chad Basin afta dem drive dem  for Iraq and Syria.

For one new counterterrorism strategy document, na US take tuk dis tuk, say places like Naija, Sahel region, Mozambique, Sudan and Somalia don see fresh increase for terrorist attacks.

According to di report, ISIS fighters and other jihadist groups dey use weak security and areas wey gornment  nor dey in control take regroup for Africa and Central Asia.

US say one of dia main goals for Africa na to stop extremist groups from building strong bases wey fit threaten American interests.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds