Sport Yarns

Lookman Shine Again, As Atlético Madrid Beat Girona 1-0

todayMay 18, 2026 5

Background
share close

By: Esther Ayoola

Super eagles’ striker, Ademola Lookman, ogbonge  goal naim Atlético Madrid  take beat Girona 1-0 for Metropolitano Stadium on Sunday.

Antoine Griezmann naim give am assist, and Lookman fire di ball enter net for di 21st minute of di game.

Dem replace am for second half with Clément Lenglet inside 63rd minute.

So far, di Naija star don score 4 goals for 11 league matches under Diego Simeone.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds