Sport Yarns

Chisora Tuk up Moral Say Anthony Joshua Go Knock Out Fury For Four Rounds

todayMay 18, 2026 4

Background
share close

By: Esther Ayoola

British boxer, Derek Chisora, don predict say Anthony Joshua go knock out Tyson Fury within four rounds anytime, both heavyweights finally enter ring together.

Chisora, wey don fight Fury three times before, tuk dis one for interview with Sun Sport.

According to am, Joshua go first face Albanian boxer Kristian Prenga for Riyadh on July 25, while Fury sef go do one warm-up fight for August before dia possible November showdown.

Chisora sti insist say despite all di tuk from Fury, na Joshua go dominate and finish di fight quick.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds