By : Jolayemi Olajide
Rivers State Governorship Aspirant for di All Progressives Congress (APC), Alabo George-Kelly, don comot body just few hours after Siminalayi Fubara announce say im no dey join body again inside di APC governorship primary race.
For statement wey George-Kelly release on Wednesday, say e take di decision after one big meeting with APC leaders.
George-Kelly talk say na loyalty, respect and leadership dey guide am for politics, and e go sti support President Bola Tinubu political movement for Rivers State.