By: Jolayemi Olajide
Lagos Oga Commisioner of Police, Tijani Fatai, strong face today, condemn di school kidnapping katakata for Oyo State.
Oga Fatai yarn dis one on Thursday, when konfam 89.5FM newsroom waka go pay am courtesy visit for im office.
As questions take reach im side concerning di security mata for Lagos, di CP yarn say, for now, Lagos dey calm and peaceful but di police still need beta help say, na corporation dey make rice full pot.
Oga fatai con sti press tuk say pipo of lagos need shine dia eyes, once any strange movement hapun, sharpaly put call across to di police, say mehn mount every conner.