OBODO NAIJA

President Tinubu Approve ₦10B Emergency Fund

todayJune 10, 2026 8

Background
share close

Oga Presido Bola Tinubu don approve make dem set up Presidential Task Force to prepare Nigeria against Ebola virus and other health issues.

Di Presido also order, make dem release ₦10 billion emergency fund sharply to help build wall of Jericho against di  disease.

Dis na According to im tuk tuk person, Bayo Onanuga, say di money go hellep di NCDC, how dem dey respond to sickness.

Dis task force, wey Chief of Staff, Femi Gbajabiamila go lead, come out after big gornment pipo meet on how to stop Ebola make e no enter Nigeria.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds