By : Shalom Ovie
Portugal coachie, Roberto Martinez, don talk say e dey impressed with Super Eagles coachie, Eric Chelle, as e dey build im own football style for Nigeria side.
Martinez talk dis one for him pre-match interview before di match, say Nigeria na strong side and Chelle don give dem clear football identity wey dey show.
Even though some key players no dey, Martinez still talk say Nigeria no be small team at all and dem fit give anybody serious wahala.
He add say wetin really catch him eye na Nigeria last friendly match against Poland, say di team organize their sef well well and dem sabi adjust quick under Chelle hand.