Nor be small gbege for Warri as Delta activist, Sherrif Mulade, don drag im party, Nigeria Democratic Congress (NDC), go court dey demand N5 billion damages.
Mulade dey vex say di party leadership sharp-ally corner di Warri Federal Constituency primary ticket wey im win, con give am to another person because of money.
Di senior man tuk say di party don abandon democracy sell the ticket to the highest bidder, and na why e go court make dem reverse di decision so di party credibility go stand as 2027 election dey draw near.
As elders dey talk, “pikin wey say im mama nor go sleep, im sef nor go wrap eye,” so Mulade don ready to give NDC sleepless nights until dem return im mandate.