By : Jolayemi Olajide
Gbege don burst for Federal High Court Abuja as DSS witness go tuk wetin im see, say former Kaduna Govo, Nasir El-Rufai, confess say e wiretap di phone of National Security Adviser, Nuhu Ribadu.
Di witness, Deji Adeyanju, tell di judge on Monday say na El-Rufai open mouth konfam dis tin during one live interview for TV sit down tuk
Adeyanju, wey be de second person to testify against El-Rufai, tuk say e dey di TV station dat same day when de former governor drop di bombshell.
E say El-Rufai clear everywhere for di interview say “na true, we listen to di conversations of di NSA.