obodo oyinbo

Ebola For Congo, Kpai 254 Pipo

todayJune 23, 2026 5

Background
share close

By: Yusuf Abuh

 

Ebola don continue im bad waka affecting more dan 1,000 people for Democratic Republic of Congo, don sti spread reach third displacement camp and kpai one 18-month-old baby girl.

Congolese gornment confirm say 254 people don kpai so far from di affected three provinces for eastern Congo.

Health report show say dem test di baby for Ebola on June 14 for Hungbe displacement camp, but she kpai before di positive result come out di next day.

African health experts don warn oh, say if dem no control am quickly, di outbreak fit pass di West Africa epidemic wey kill more dan 11,000 pipo between 2014 and 2016.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds