By: Yusuf Abuh
Vice-Presido, Kashim Shettima don direct National Emergency Management Agency, NEMA, and other gornment agencies make dem start work for flooding now, make e nor con spoil something later.
Di senior man vice presido give dis order on Thursday during meeting with di emergency task force pipo for Aso Villa, Abuja.
Dis one follow National Economic Council approval of N83.2 billion on June 18 to support plans wey go reduce flood impact.
Shettima say, agencies gat make every tin clear oh to protect lives and property before rain go start fall spoil tins for Nigeria