Di Minister of Education, Dr. Tunji Alausa, don drop micro soft word say gornment go stop di policy wey dey separate Junior Secondary Schools from Senior Secondary Schools.
According to FG di reason why dem do am like dat don fail.
Oga minister of education yan dis one as dem announce di Ministerial Committee for Abuja on Tuesday.
Di explanation go shock u, say policy make children drop out from school once dem finish junior secondary school.
Government konfam say na over 20 million pikin don stop school between primary and secondary levels.