Local

FRSC Warn Drivers As Heavy Rain Flood Lagos-Ibadan Expressway

todayJuly 1, 2026 9 1

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Di Federal Road Safety Corps (FRSC) for Ogun State don warn drivers make dem get patience and stop to dey drive face traffic, especially for Lagos-Ibadan Expressway.

Na Sector Commander, Oludare Ogunjobi, give dis advice after heavy rain flood di expressway on Tuesday, wey come make some drivers pass one-way and cause heavy traffic jam.

Ogunjobi say if drivers dey rush and dey break traffic laws, e go only make di hold-up worse for everybody.

Im come press yans say FRSC officers go only try dia best, and dat drivers need to hear word, to stop all di plenty traffic jams for area.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds