OBODO NAIJA

 FG Tell Nigerians For South Africa Not To Fear, Say Dem Dey With Dem

todayJuly 1, 2026 8

Background
share close

Federal Gornment don assure Nigerians wey still dey South Africa say dem safe, even as fresh xenophobic protest don raise fear across di country.

Another 269 Nigerians wey government evacuate don land Lagos from Johannesburg, while reports say gunmen kill one Nigerian businessman wey dem sabi as Big Joe for Mpumalanga.

Thousands of South Africans march for different cities, dey demand make undocumented foreigners comot, as police deploy security to stop violence.

Even though police say most of di protests remain peaceful, some looting, vandalism and attacks happen, forcing many migrants to run from dia communities.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds