Former President Olusegun Obasanjo don warn say plenty of di things wey cause Nigeria Civil War for 1967 still dey ground, and everybody must join hand make dat kind wahala no happen again.
Obasanjo tok dis one on Wednesday as e receive book, research materials, videos and interviews about di Asaba Massacre from Chief Chuck Nduka-Eze for di Olusegun Obasanjo Presidential Library, Abeokuta.
E praise Nduka-Eze for keeping di history alive, say if people know wetin happen before, dem go avoid civil war by all means.