By Oluwatosin Ibrahim
Nor be small tin for naija politics, as APC and opposition parties dey get am hot, hot say, di 2027 presidential candidate of di Nigeria Democratic Congress (NDC), Peter Obi, raise alarm, say im life fit dey danger.
Di All Progressives Congress through dia National Seco, Senator Ajibola Basiru sharpaly dismiss di claim,say, no level, and dat na fear dey do di NDC, and Obidient Movement Worldwide. Wetin concern one faction of PDP, nor body know, but dem too, sef don fire back, dey accuse di Federal Gornment say dem dey target opposition leaders.
Dem also tuk say gornment must take responsibility if anything hapun to Obi.