By Oluwatosin Ibrahim
Former Edo State Govo and Senator, Adams Oshiomhole, don scata table oh, say bad belle pipo wey dey fight against state police dem nor wise and dat state police na di way to go for Nigeria.
Im yarn dis one on Thursday, for one TV town Hall meeting, wia im tuk im mind dat, normally dat Nigerians suppose to dey celebrate Wi oga Presido for creating state police.
Oshiobaba explain dat gofners nor too get power if dem nor get di opportunate to control dia own police and dat opportunity don come and dat we suppose celebrate am.