By Oluwatosin Ibrahim
Even though supply of cooking gas don improve after Federal Government intervene, many Nigerians don dey complain again say dem sti dey buy gass for ₦1,650 per kilogram.
U sabi say, President of di Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers, Edu Inyang, say government action help stop panic buying and make gas begin flow well again.
Before di scarcity wey start for May, one kilogram of cooking gas dey sell for less than ₦1,000, but di price later jump reach about ₦2,500 for some areas.
Despite di better supply, Inyang say cooking gas still cost too much, and plenty families across di country still dey struggle to afford