By: Esther Daniel
African Democratic Congress (ADC) don raise alarm over wetin e describe as appointment wahala for Presido Bola Tinubu administration.
Di party say National Assembly suppose investigate whether di Presido still dey fit to perform di duties of im office.
According to statement wey National Publicity Secretary, Bolaji Abdullahi, sign, one man wey presidential directive remove from office still dey occupy di position and hold meetings with top gornment officials.
ADC say di development dey raise serious questions about how di Federal Government dey run its affairs.