Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve make Nigerian Army increase from eight divisions reach 12 divisions, and make dem recruit 28,000 new soldiers.
For statement wey Bayo Onanuga sign on Thursday, e tok say four new divisional headquarters go dey for Makurdi, Ilorin, Jalingo and Benin City.
According to wi presdio, dis plan go hellep security agents respond to any threats sharp sharp and to make border security strong wella wella.
Under di new arrangement, each army division go cover different states across di country to make security work better.
Onanuga tok say under di new arrangement, 1 Division Headquarters go dey Kaduna and go cover Kaduna, Kano, Katsina and Jigawa States.
2 Division Headquarters go dey Ibadan and go cover Oyo, Osun, Ekiti and Ondo States, while 3 Division Headquarters go dey Jos and go cover Plateau, Bauchi and Gombe States.
5 Division Headquarters go dey Makurdi and go cover Benue, Nasarawa and Kogi States, while 6 Division Headquarters go dey Port Harcourt and go cover Rivers, Akwa Ibom and Cross River States.
7 Division Headquarters go dey Maiduguri and go cover Borno and Yobe States. 8 Division Headquarters go dey Sokoto and go cover Sokoto, Kebbi and Zamfara States.
9 Division Headquarters go dey Ilorin and go cover Kwara and Niger States.
10 Division Headquarters go dey Jalingo and go cover Taraba and Adamawa States.
81 Division Headquarters go dey Lagos and go cover Lagos and Ogun States.
82 Division Headquarters go dey Enugu and go cover Enugu, Anambra, Abia, Ebonyi and Imo States.
83 Division Headquarters go dey Benin City and go cover Edo, Delta and Bayelsa States.