OBODO NAIJA

Gunmen Scatter PVC Sharing For Osun, Carry Voter Cards Go

todayJuly 27, 2026 7

Background
share close

By: Esther Daniel

Some people wey dem suspect say na hoodlums storm one INEC PVC collection centre for Oyinlola DC School, Okuku, Osun State on Sunday and carry some packs of Permanent Voter Cards comot.

Witnesses tok say di men enter di place quietly before dem begin shoot for air, make everybody run for safety.

Di attack scatter di PVC sharing exercise as people wey come collect dia voter cards run different directions to save dia life.

One resident, Gbadebo, say di hoodlums go straight where INEC staff keep di PVCs and carry some packs before dem escape.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds