OBODO NAIJA

Pay N40m Ransom or Else

todayJuly 28, 2026 6

Background
share close

By: Esther Daniel

Gunmen don kidnap INEC staff Christy Nkiru Okeke along di Ebenebe axis for Awka North Local Gorment Area of Anambra State.

Security sabi person Zagazola Makama report say di bad boys carry di woman on July 24 at about 7:00pm as dem dey attack people for di area.

Di victim husband done run go B Division Police Station for Awka report say di kidnappers dem call am demand N40 million ransom to free him wife.

Dis abduction happen just one hour after another businessman Emmanuel Nwobodo narrow escape death when gunmen shoot him Benz car near Ebenebe Community Secondary School.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds