OBODO NAIJA

Oga Presido Military Salary Increase Scatter Political Space

todayAugust 6, 2026 1

Background
share close

By: Jolayemi Olajide

 

Oga Presido Bola Tinubu approval of new salary package for Nigerian Armed Forces don cause mixed reactions from opposition parties as dem argue over di reason behind di move.

Social Democratic Party and New Nigeria People’s Party welcome di salary increase during interviews for Abuja on Tuesday, saying better pay go improve soldiers welfare and strengthen national security.

But Labour Party and Obidient Movement question di timing of di announcement, saying Nigerians need consider di administration’s political record before judging di decision.

Di parties give dia separate reactions after Oga Presido approve di new military pay package, with some describing am as long overdue while others say political motive fit dey involved.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds