By: Esther Daniel
Oga presido Bola Tinubu on Thursday direct EFCC make dem immediately return to court and cancel di order wey freeze Osun State Gornment account, after di action cause public criticism ahead of di August 15 gofnorship election.
Tinubu, through im spokesman Bayo Onanuga, say although EFCC get power to do investigations, di timing of di account freeze embarrass am because people fit see am as political interference.
Di Presido explain say since im assume office, im don allow anti-corruption agencies work independently without interfering in dia operations because strong institutions dey important for democracy.
Tinubu therefore order EFCC make dem discontinue di court action against Osun State Gornment to protect public confidence in di democratic process.