Osun Governorship Election

10 Results / Page 1 of 2

Background

south west

Adeleke Collobi Second Term, Beat APC Candidate Oyebamiji by 66,252 Votes

By Ebi Oboko Gofnor Ademola Adeleke don win Osun State gofnorship election again after e collect 511,067 votes for Saturday election. Di Returning Officer, Professor Joshua Ogunwole, announce di result for INEC Collation Centre for Osogbo early Sunday morning. Adeleke, wey contest under Accord Party, beat im closest challenger, APC candidate Bola Oyebamiji, wey get 444,815 votes. With di result, Adeleke get winning margin of 66,252 votes ahead of Oyebamiji. […]

todayAugust 16, 2026 66 11

Politics

Osun Election: 1.9m Voters Ready To Decide Gorfnor

By: Kofoworola Olayinka About 1.9 million voters go decide Osun gorfnorship election tomorrow, with 15 candidate contesting di poll. President Bola Tinubu don assure resident of security and beg dem to come out vote. Fear rise after suspected political thugs allegedly shoot two APC members for Esa-Oke, as 15,000 policemen and other security workers dey send Gorfnor Ademola Adeleke, APC candidate Bola Oyebamiji and ADC candidate Najeem Salaam dey among […]

todayAugust 14, 2026 18

south west

FRSC Send 2,500 Worker For Osun Election

By: Kofoworola Olayinka FRSC don send 2,500 worker and 50 vehicle to manage traffic for Osun gorfnorship election on Saturday. Di sending cover all three senate districts and operational areas across di state. FRSC say dem include seven tow truck and six ambulance for emergency response. Di agency say di move na to ensure smooth traffic, quick response and obey with movement restriction during di election.

todayAugust 14, 2026 15 1

OBODO NAIJA

Makinde Ask “Nigerian Economy Dey Grow, But Nigerians Dey Feel Am?”

By: Esther Daniel Oyo State Gofnor Seyi Makinde don ask whether Nigerians dey feel di impact of Nigeria’s growing , for im August 2026 newsletter, “Di Business of Governance,” because economic growth suppose improve people lives. Makinde tok say Oyo State and National Bureau of Statistics don release fresh economic figures, wey show say GDP(Gross domestic product ) dey grow, gornment revenue dey rise and budgets dey get implementation. Di […]

todayAugust 10, 2026 19

Politics

Osun APGA Candidate Comot for Race, Back APC Candidate

By: Esther Daniel Osun APGA gofnorship candidate, Adesina Adeyemi-Doro, don comot for di race and support APC candidate because e say na di best interest of Osun people. Adeyemi-Doro talk for One Tv show on Monday say e make di decision after serious thinking and consultation. E say e enter politics to serve people, no be just to get political office, and good leader suppose put people interest before personal […]

todayAugust 10, 2026 17

Entertainment

Davido Reply Edo Governor Over Wetin E Talk About Adeleke

By Oluwatosin Ibrahim Afrobeats star Davido on Friday react to Edo State Governor Monday Okpebholo by sharing wetin appear to be im WAEC result for Instagram after di governor mock Osun State Governor Ademola Adeleke during APC campaign for Osun election. Okpebholo, while campaigning for APC candidate Bola Oyebamiji on Thursday, ridicule Adeleke’s dancing style and claim say e dey distract am from governance. Davido, wey dey actively support im […]

todayAugust 7, 2026 25 1

Politics

Tinubu Order EFCC Make Dem Unfreeze Osun Gornment Account

By: Esther Daniel Oga presido Bola Tinubu on Thursday direct EFCC make dem immediately return to court and cancel di order wey freeze Osun State Gornment account, after di action cause public criticism ahead of di August 15 gofnorship election. Tinubu, through im spokesman Bayo Onanuga, say although EFCC get power to do investigations, di timing of di account freeze embarrass am because people fit see am as political interference. […]

todayAugust 6, 2026 16

Politics

Adeleke Beg Osun People Make Dem Reject APC for August 15 Guber Election

By: Esther Daniel Osun State Gofnor and Accord gofnorship candidate, Ademola Adeleke, don call on voters for Osun State on Thursday make dem reject APC for di August 15 gofnorship election, say na so dem go protect di progress wey im administration don make. Adeleke tok say APC make civil servants suffer during dia time for office by paying half salaries, and say many workers no fit feed dia families […]

todayAugust 6, 2026 17

Politics

Davido Beg Osun Pipo Make Dey No Fight for Election Period

By: Esther Daniel Afrobeats star Davido don beg Osun residents make dem maintain peace and shun any form of violence for Osun  gofnorship election. Davido yarn dis one as head of youth campaign mobilisation team for Gofnor Ademola Adeleke, wey be im uncle. Di singer praise Adeleke as one of di best gofnors Osun don get and encourage eligible voters make dem come out peacefully go vote without fear or […]

todayAugust 6, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds