crime& security

NDLEA Bust Cocaine Cartel, Arrest ‘KC Luxury’ As E Try Run From Nigeria

todayAugust 19, 2026 8

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

NDLEA don bust one international cocaine cartel wey allegedly dey use Nigeria as road  to move illegal drugs go UK, Europe and Asia.

According to report say dem  arrest di alleged Nigerian leader of di group, social media influencer Afolabi Kazeem Michael, aka KC Luxury.

NDLEA Chairman, Brigadier General Mohamed Buba Marwa, yarn dis one for Lagos on Tuesday,

Di agency say e arrest am as e dey try comot Nigeria, while dem seize 184.50 kilogramme of cocaine from di operation.

Di agency say di cocaine seizure na di biggest wey any courier company for Nigeria don record.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds