obodo oyinbo

Iran Knack Chest Say Dem Ready To Face Fresh US Sanctions

todayAugust 25, 2026 6

Background
share close

Iran don talk say e ready to withstand di wider sanctions wey United States announce to isolate di country from di global economy.

Iranian Economy Minister Ali Madanizadeh say Tehran fully prepared for di measures and believe say dem go lead to another defeat for America.

US Treasury Secretary Scott Bessent say any country, bank or business wey continue financial dealings with Iran go face isolation if dem refuse to cut ties.

Bessent describe di new measures as di biggest financial offensive ever against Iran, saying di sanctions go block Iran sources of revenue and put more pressure on di country.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds