Politics

Peter Obi Ask Why Tinubu Wan Hide Im Past Records

todayAugust 31, 2026 2

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

NDC presidential candidate, Peter Obi, don question  Presido Bola Tinubu on why e dey ask foreign court make dem withhold records about im past.

Obi raise di matter for statement wey e post for im official social media page on Monday.

E say Nigerians deserve answers on matters wey concern public interest, especially issues around di Presido educational records.

Obi say sitting Presido suppose get courage to face questions about im past, instead of trying to stop legitimate scrutiny of such records.

E describe di situation as embarrassing, saying Nigerians deserve transparency when important questions dey come up about dia leaders.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds