By: Kofoworola Olayinka
Igbo Heroes and Icons Foundation don give Benue Gofnor Hyacinth Alia 24 hours to identify and arrest suspected thugs wey allegedly block Peter Obi convoy for Makurdi-Gboko Road on Tuesday.
Di group say Obi dey enter Benue to sympathise with families wey lose loved ones for Yelwata killings, but youths carrying sticks and other objects reportedly stop am and force am turn back go Plateau State.
Foundation say di incident raise serious concern about political tolerance and freedom of movement, as dem condemn any attempt to use thuggery or intimidation stop any Nigerian from moving freely.
Di group urge Gofnor Alia, as di state Chief Security Officer, to ensure say di suspects face di law, especially as Benue Gornment don deny involvement and di group say dis make independent probe necessary