By: Mariam Ajayi
FCT Minister, Nyesom Wike, don tok say Kwara State Gofnor, Abdulrahman Abdulrazaq, dey always blame am for anything wey happen for im office or house.
Wike talk dis one for interview with tori pipo on Tuesday, say anytime di Gofnor see snake or any kind reptile, e go say, “Na Wike.”
Di FCT Minister also accuse Abdulrazaq say e dey focus more on gossip instead of doing di work wey people elect am to do.
Wike make di comment while e dey react to support from Rainbow Coalition for Presido Bola Tinubu’s re-election bid and criticism wey some APC governors don make.