Vice Presido, Kashim Shettima don reveal on Wednesday say na only six out of 19 northern Gofnors support President Bola Tinubu presidential ambition for di 2023 election.
Shettima talk dis one for di palace of Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari, during di turbaning of Kwara Gofnor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate.
E say di tension wey follow di 2023 presidential campaign and election dey very clear, and na person wey strong-hearted and determined fit continue to pursue im ambition under dat kind pressure.
Shettima tok say we get 19 states for North, and na only six really believe and support Tinubu, but Tinubu no allow dat one stop am, as e still push on and e manage cross di road.”