Politics

Shettima Tell Kwara Politicians Make Dem Settle Election Mata

todaySeptember 17, 2026 2

Background
share close

By: Ayobami Dada

Vice Presido, Kashim Shettima say Presido Bola Tinubu don show political maturity by forgiving northern govos wey no support im presidential ambition for di 2023 election.

Shettima tok dis one on Wednesday for Ilorin during di turbanning of Kwara State Governor, AbdulRahman AbdulRazaq, as Sardauna of Ilorin Emirate by di Emir of Ilorin, Alhaji Ibrahim Sulu-Gambari.

As 2027 election dey come closer, Shettima tell politicians make dem see political contest as temporary and no allow election disagreement divide dem forever.

He remember how Tinubu face opposition during di 2023 presidential election, but still continue im campaign even though only few govos for di North support am.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds