Obodo Niger

Ondo Gofnor give kidnappers, criminals 14 days to comot from forest

todaySeptember 17, 2026 2

Background
share close

By: Ayobami Dada

Ondo State Gofnor, Lucky Aiyedatiwa, don give kidnappers and other criminals wey dey hide for di state forest 14 days to comot.

Di Gofnor Senior Special Assistant on Forestry, Bidemi Obayangban, make dis one known during interview with newsmen on Wednesday for Akure.

Obayangban say di order dey mainly target kidnappers and other criminals wey dey use di forest as hideout.

And e add say di move na part of efforts to make Ondo safer and allow legit business to grow, as security dey important for di state plan to develop di forestry sector and bring investors.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds