OBODO NAIJA

Tinubu Fit Settle Wike, APC Gov Palava For France

todaySeptember 18, 2026 3

Background
share close

By: Mariam Ajayi

Presido Bola Tinubu fit intervene for di growing wahala between some All Progressives Congress governors and FCT Minister Nyesom Wike ahead of di 2027 elections.

One senior presidential aide talk say Tinubu dey expected to bring di two sides together to settle dia differences. Di aide say di meeting fit happen for abroad before di end of di week, as Tinubu dey currently on vacation for France.

Wike, wey be Pipo Democratic Party leader but dey serve for APC-led Federal Government, dey promote Rainbow Coalition for Rivers State to support Tinubu for 2027.

Wike recently accuse Kwara Governor AbdulRahman AbdulRazaq and Imo Governor Hope Uzodimma of being behind some of im political challenges.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds