Oyo State Govo, Seyi Makinde don accuse Federal Capital Territory Minister, Nyesom Wike say he dey drop banga.
Makinde tok dis one on Tuesday for Makinde/Daura 2027 Presidential Town Hall meeting for Katsina, say Oyo State Gornment no receive any N50bn from di Federal Gornment, say na di state gornment use dia money take upgrade di Ladoke Akintola International Airport for Ibadan.
Remember say, Wike do interview with tori pipo on Monday and na there he make di claim say Presido Bola Tinubu dash Oyo State Gornment N50bn for di airport project.
But Makinde insist say di state gornment carry out di project without any N50bn from Federal Gornment, adding say Wike’s claim say Federal Gornment provide money for di airport project na be truth.