For di Bad belles and opposition, ogbonge update oh, baba, aka Jagaban, President Bola Tinubu just land Lagos yesterday from holiday, incase u dey think say senior man dey sick, as senior man say hin don ready for di 2027 race, person wey leg nor strong comot body.
Na so e tell all di news tatafos for airport, comot body, comot body, energy dey fully 100 percent.
Baba seyi say hin dey feel am, ready to scata ground and ready to work.