By: Mariam Ajayi
Ukrainian Presido, Volodymyr Zelensky don drop hin mouth odour unto how dem go take end di war for Urkain, say US presdio Donald Trump go tell Russia to agree 60 days ceasefire.
Dis one dey come after Trump cast everywia with hin mouth odoour on Saturday say Ukraine need new president wey go agree peace deal.
Zelensky dey respond for interview with ABC News on Sunday say, hin nor get problem if Ukraine need new presido, with all respect to Trump, but na Ukrainian people get the power to choose who go rule dem, no be outsider, say Tump kpomkpi for wia hin dey.