Lagos

Truck Askident Happen for Kara Bridge and Shasha Roundabout

todayOctober 27, 2026 5

Background
share close

 

Two truck askident shele for Kara Bridge and Shasha Roundabout on Tuesday, as one tipper wey no carry load hang for bridge rail, and another truck scatter im load for road as e dey face Mowe, Ogun State.

One LASTMA official say dem report di Kara Bridge mata around 7am, as police from Adigboluja and towing motor sharpaly reach di place where di askident happen.

Anoda one happen For Shasha Roundabout, as one loaded lorry spoil and block about of di road as e dey face Akowonjo Roundabout.

LASTMA say dem don call motor to carry di lorry comot, and officers dey try control motor movement for both places.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds