Afta Lagos record 1,685 fire askident wey kpai kpai 133 pipo and destroy properties of billions naira for 2025 alone, market leaders say enough don dey enough, dat dat all traders gat do insurance. With di insurance if your business burn dem go get wia dem go get money fund u, so far nor be u cause di fire by yourself.
De President of Ndigboamaka Progressive Market Association, Chinedu Ukatu, make dis call for Lagos on Monday during by di time dem dey porporly matas on one documentary titled Burning Point: Inside Lagos Fire.
Ukatu explain say traders often lose everything when fire strike, but dem go still dey carry de heavy burden to pay back bank loans wey dem collect take run de business, so na to avoid dis kind anyhow doings.