Di Lagos state gorment don give all Lagosians deadline to go do health insurance cause say di way pipo dey sick for di obodo Lagos dem nor like am.
Na Lagos State govo, Babajide Sanwo Olu naim porporly dis one on Tuesday as hin do flagging off DI enforcement of mandatory health insurance under Executive Order EO/BOS/01 of 2024.
According by di Govo tok tok person, Sanwo-Olu adon release di Lagos Private Health Plans, wey go help care for both private and public workers for di state, di deadline na December 31 oh, every worker must get health insurance.