Article

Jesús de Miguel Kpai After Serious Jam Body

todayNovember 4, 2026 6

Background
share close

Football world don dey mourn after CD Tenerife striker, Jesús de Miguel, kpai after e jam body with FC Andorra goalkeeper, Jesus Owono for inside Spanish second division match on Monday, November 2, 2026.

Di badness happun for Matchday 12 of di 2026/2027 LaLiga Hyper Motion season for Estadio Heliodoro Rodríguez López, Santa Cruz de Tenerife.

For di seventh minute of added time (90’+7), when di match don reach 2-2, FC Andorra goalkeeper, Jesús Owono, rush come out to clear long ball but jam body with De Miguel, as im knee hit di striker for chest.

De Miguel fall for ground on di spot suffer cardiac arrest, together with serious injuries for im head and chest. Di referee sharpaly comot red card from hin pocket give  Owono as medical personnel rush enter pitch to attend to di striker.

Medical team spend more than five minutes dey perform Cardiopulmonary Resuscitation (CPR) and emergency treatment on am before dem carry am go University Hospital by ambulance.

Players from both teams no fit hide dia emotions as dem watch as di thing dey go, some of De Miguel teammates even burst tears, dey cry and dem later suspend di match.

 

Official Announcement Say De Miguel Don Kpai

On Tuesday, November 3, 2026, CD Tenerife announce say De Miguel don kpai at exactly 8:00 a.m. Spanish time, wey be 7:00 a.m. for UK.

Di 30-year-old striker reportedly kpai following cardiorespiratory arrest and cardiac arrest wey happen after di collision.

Following im death, Spanish Football Federation postpone all matches wey dem schedule for Tuesday, including Copa del Rey and Copa de la Reina fixtures.

Di football governing body also cancel official presentation of Spain Under-21 international match against Japan as mark of respect to De Miguel, im family, teammates and Tenerife supporters.

Meanwhile, European football oga dem, UEFA, announce say dem go observe one-minute silence before all European matches dis week.

Spanish clubs Atlético Madrid, Barcelona and Villarreal wey get Champions League matches on Tuesday also observe di silence.

According to reports, Spanish police don open investigation into possible “involuntary manslaughter”  as De Miguel kpai

Under Spanish law, any death wey authorities classify as “non-natural” go automatically trigger judicial investigation.

However, dis one no mean say anybody commit crime, as di investigation go determine exactly wetin kpai di striker.

 

Previous Cases of Footballers Wey Kpai After Dem Jam Each Other for Field

For 2014, Indonesian footballer, Akli Fairuz, suffer serious internal injury after im jam body opponent goalkeeper inside match for Persiraja Banda Aceh, and im later kpai days after di askident sake of internal complications from di wunjury.

For January 1987, Málaga goalkeeper, José Antonio Gallardo, suffer serious head wunjury and bleeding inside im brain after e jam with opposing player inside match against Celta Vigo, and e later kpai from di wunjury.

Another case happen for August 1954 when Portuguesa player, Walter, collapse inside match shortly after opposing player use force take foul am. Reports later tok say na stroke kpai based on di askident wey happun.

 

FC Andorra Reacts As De Miguel Kpai

FC Andorra, di club wey face Tenerife during di match, don express shock and sadness over wetin happen.

For statement wey dem release on Tuesday, di club send condolences to De Miguel family, CD Tenerife and everybody wey dey close to am.

Di statement read say:

“Dis badness affect us deeply and we follow di club share di pain of wetin happun.”

Di club add say dem don maintain contact with Tenerife since di askident and dem ready to provide any help wey dem need.

Who Be Jesús de Miguel?

Jesús de Miguel na Spanish striker wey dem born for Madrid. Him begin hin professional football career with Leganés for 2015 and go on to play for eight different clubs across Spain.

Some of di clubs wey him represent include Lugo, Fuenlabrada, Internacional Madrid, Unión Adarve, Navalcarnero and Unionistas.

Hin later join Castellón for 2023 and score 16 goals as di club secure promotion to Spanish second division one year later.

For 2025, De Miguel sign three-year contract with CD Tenerife.

Before him death, di striker don make 29 appearances for Tenerife and score 11 goals.

De Miguel leave behind him daughter, Carla de Miguel Fernández, wey dem born for 2025.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds