Di Head of Department, Voter Education and Publicity, INEC Lagos State, Esther Emeh, don explain wetin vote buying and selling mean, di punishment for anybody wey chook hand and how voters fit report offenders.
Emeh tok dis one during for siddon tok with Konfam FM today, Thursday, November 5, 2026. She explain say vote buying and selling mean and also draw ear give pipo wey dey chook hand inside dis kine thing .
She tell voters and party agents wey see anybody dey buy or sell vote make dem report di matter to police, as INEC no get power to prosecute offenders by itself. She also say INEC dey visit markets and grassroots areas to educate pipo on di dangers of vote buying and how to reject such offers.