Lagos State House of Assembly don come again say dem support one committee report card wey tok say dem go dey touch light handwork pipu doings for inside di Obodo Lagos to avoid anyhow behaviour.
Na di Chairman of di Committee, Honorable Tobun Abiodun na im carry di mata for head say dis new law go hellep guide di state from anyhow jobmen.
Di bill carry beta arrangement to hellep registered job men to get money from gornment to support dia business, buy modern tools, and upgrade dia work skills.
Following final tok on top di matter, Right Honorable Speaker, Mudashiru Ajayi Obasa come order di Clerk make she send clear copy of di bill go give Govnor Babajide Sanwo Olu make hin sign am enter law.