LASTMA , rescue 17 pipo, plus di driver, after one CNG bus catch fire for Berger Bus Stop along Lagos-Ibadan Expressway today, Wednesday, November 11, 2026.
Di Toyota Hiace bus, with number EKY 798 YK, dey carry 18 pipo from Mowe-Ibafo come Lagos when e suddenly catch fire after reported gas burst.
One male passenger wey siddon for di back suffer serious burn.
Dem quickly carry am go Lagos State Trauma and Emergency Centre for Toll Gate for treatment.
LASTMA Director of Public Affairs, Adebayo Taofiq, say Fire Service men quench di fire, while Ojodu police secure di area.
LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki, clap hand for di workers wey rescue di pipo.
E also drag ear give bus operators, especially CNG bus owners, make dem dey check dia gas tanks and pipes well to avoid dis kind wahala.